Olympiacos vs. Arsenal [Match Preview in Pidgin]
Written by @Jamilah11
So I still dey buzz from that 3 points wey we gain over the weekend. That definitely made my weekend except that ManUre and Chelski both won their games, but nevertheless we dey on 5th position now and I just dey pray sey make Liverpool lose or draw so we go retain our position. (Update: Her prayer was answered, Liverpool lost to Fulham earlier today)
Anyhoos, make we talk today’s business. Champions league preview against Olympiakos. This time we dey travel go Greece go face them for match wey no get any effect for us. Because even if we draw, lose, or win we go still top our group and qualify. We thank God sey we no get any pressure so everybody fit relax and just enjoy the game. The thing just dey make my belle sweet because the other three English teams dey struggle to qualify , so e go be really good night for those of us wey love to dey torture manure, Chelski and Man$hitty them. But na game we suppose play. And this one na opportunity make our reserves also get champions league playing time.
As we dey now, na us dey top our group as I mention before. We get 11 points for hand now, while Marseille wey dey just behind us get 7 points so even if them win the match against Dortmund, we go still dey ahead of them. Olympiakos them dey 1 point behind Marseille so for them to qualify, them go need draw or win us and hope sey Dortmund win against Marseille
Earlier before, when we play them for emirates, na we win 2-1, but them really give us problem for our defense and If we fit remember well, that time wey we dey the same group with them in the 2009/2010 CL group stage, we win the home game, but when we travel go their side, them win us with 1-0. So I dey hope make things change this time around.
For me this na game wey the manager go use test our reserves, so me I dey think sey Professor go make eleven changes so we go fit test the reserves and rest our key players for match wey we get for weekend against Everton who dey even struggle to get goals.
With Ryo and Diaby injured and Roscisky a doubt (Update: Rosicky travelled with the squad to Greece), I doubt sey them go play Ros even if he fit play. Make we no take any risk for this game wey we no really need anything from am, but we go need am for experience but I sure say we fit manage without am. I go really like make reserves like Yennaris, Coquelin, Chamberlain start this game with Park leading the attack and benching Chamakh, and the Dench master himself holding it down for midfield.
All in all, I’m looking forward to a good game and good weeknight of fun football as I can’t wait to make fun of those out of the English teams who wouldn’t make it.
Predicted Score: 2-0 Park, Chamberlain.
Predicted 11: Fabianski, Miquel, Djorou, Squilacci, Yennaris, Frimpong, Coquelin, Arshavin, Yossi, Chamberlain, Park.
You can follow @Jamilah11 on Twitter.
Posted on December 6, 2011, in Arsenal, Match Preview, Pidgin English and tagged Arsenal, Football, Olympiacos, Pidgin English, Premier League. Bookmark the permalink. 2 Comments.






Just hope Rosy no go pick injury as him don improve well on him defensive side especially for this period wey games shewa anyhow.
1 -1 Final scores. 2 Olympiakos scorers… Meaning they’ll score an own goal…